Wednesday, 9 October 2013

Anonymous Pidgin Letter To President GEJ On ASUU Strike

Not my handi-work oh. .
I received this. .and decided to share
Oga Presido,
First of all I hail ooo! I no say u no dey cary
last. You be confirm warri pikin. But ur
middle name Ebele means mercy and make
u pity ur children settle their lecturers naa!
The matter neva tire u? Suppose say ur
pikin wey u born for belle follow us dey
house, Sheeh you for never answer our we
lecturers them? Una say make we bone
kidnapping, militant things and all the bad
bad things go enter school, now now na
una com dey f**k up. All the things wey
them lecturers don teash us for klass we
don forget am finish. Last last, na una go
still call us “half-baked”, “half-roasted”, abi
na “half-fried”. Na una sabi.
Them talk say person no fit run pass him
shadow.
We go dey lasgidi dey for you. Na ur time
be dis use am well, but we go catch you for
2015. U don forget say youths na we dey
vote pass. Na we too dey snatch ballot box,
dey do rally and som kain kukere things
them wey them dey take win election. U go
still nid our help. That time too we go go
strike. Shebi u sabi waka for bare feet, u go
carry ur leg do ur rally. No thugs for u. We
no go snatch ballot make you for win. If
any maga try am we go fall am.
So Oga Jona, na ur opportunity be dis ooo.
Make u code this stubborn ASUU make dem
cary their wahala goback. We no say na
rush them go rush us we no send. All join.
Na who get leg dey pass exam no be who
read. Na still who get leg dey get beta
work. Na Naija we dey. So make u do
something because our mate dem for
private university don graj finish. We don
tire to dey beef them. If u no shake bodi
fast make u no forget say university of
militancy still dey admit. Dey neva release
2nd batch ooo!
May u grit maale Patience for we, thank
baba God say she and gran papa Soyinka
don settle that their quarrel, 2 agbayas,
plus all those bad belle advisers wey u get.
God pass them! Bros Amaechi still dey
Niger-delta here, the guy don tire for ur
mata. We dey grit u for am too. We go stop
for here. E go be na. Naija! student for life!
Na ur waffi boy.
http://www.yabaleftonline.com/2013/10/
hilarious-pidgin-open-letter-to.html

Published with Blogger-droid v2.0.10

No comments:

Post a Comment